Everywhere Go First Blur
As you enter the plane to take japa, you been think say everywhere good, based on belief!
You been buy all the sweet mouth way people dey yarn online. But as you land, you see say water done pass garri, e done dey blurry small small… everywhere come dey blur, e get as e be.
The way the agent take explain am for social media, especially for TikTok and Twitter dey different from wetin dey play for your front. E reach your turn to come Europe, dem say job market crash, as Lapo baby wey yu be, people way loan you money done Dey call from Naija. E done dey blur, hunger wan wound your mama, the matter get as e be.
![]() |
| Everywhere, go first blur |
Everywhere go first blur when things no go as you reason am. The city cold, the weather blur your eyes; as you no see food chop, everything just blur. As you dey reason your life, everything just deh blurry because you never sure of the direction way you wan go.
![]() |
| bank of the sea |
E cold for inside as your belle dey turn, e come for outside as you deh hustle to make ends meet.
As everything blur, you gahs maintain faith and hope, believe say your time deh come. E go better, believe! Everything way blurry today, go clear tomorrow, just use water dey wash your eyes when pepper enters inside your eyes.
![]() |
| Welcome to Helsinki |





Comments
Post a Comment